ALARM DON BLOW
Eferi plan don scatter Katakata jam yamayama Moto dey boil like Firewood soup Moue people dey baff for sweat: Alarm don blow For Lagos go slow.
I-go-drive-mysef kiss De yansh of Eko taxi Grammar jus fly comot From eferi corner: “Gaddem! Nonsense! I drive in London Ten years no problem.”
Dem park for road
Dey block eferibodi: My people, alarm don blow For Lagos go slow. Gofment oga wan go airport Na so alarm come blow Becos all road don close. I sweat reach bucket for molue Still oga nefer pass But sha, after two hour Siren come blow And oga fain im way. Alreadi, alarm don blow For Lagos go slow.
Hit-and-run driver jam Person for Eko bridge Eferibodi dey hala Some dey do kiss of life Oders bicom emergency dokita: Ojuelegba na casualty ward Eko bridge don bicom moto park. Alarm don blow Inside Lagos go slow. Morning go slow
For Carter bridge Night go slow For Mile two Ikorodu road Na all weather. You comot from work: Go slow You dey go work: Go slow You dey fain job: Go slow You dey fain business: Go slow. Go slow, go slow You don go nuclear Your alarm wan Blow my ear comot. Go slow, go slow Your wahala tire me. |