For our place na good thin Wen somebody get belle But dis Africa belle Don overmature Na real bad belle.
Na wen e go deliver
Soso famine and kwarshiokor borku And beggar, beggar contri eferiwhere. Long, long time after slavery And efensef colonial master don comot Still Africa no wan deliver. Bifor, bifor wen Oyinbo come
Na some Africa man sell dem broder Again, again dem dey hala for IMF and Im cousin World Bank. Dis time dem go blow grammar for UN and OAU Becos dem be independent contri abi? But my sista, na all of us sabi say Na only flag we get: Our maiguard dey combine with armu robber ! Africa get belle
E don overdue Belle no wan comot Na so Africa dey roll for ground Becos de pain don pass mental: Africa get belle Na wen e go deliver?
Luca Lang
Copyright dey for dis work o. |